Croatia knock out 'confident' Brazil from Qatar 2022 Fifa World Cup

Croatia knock out 'confident' Brazil from Qatar 2022 Fifa World Cup

Weda Croatia go fit tame Brazil for di first quarter final match for di Qatar 2022 Fifa World Cup na wetin pipo go wan see.

Brazil dey pay attractive football wey don make many fans dey tip dem to win di tournament.

Di Selecao tear South Korea apart overwhelming attacking performance for dia last-16 game.

Even di manager Tite enjoy di game sotay e join dem for di Samba celebration for dat 4-1 win.

On Friday, dem dey play a traditional Croatian side wey no dey play trendy style but dey always enta major stages of all di competitions wey dem involve.

Croatia, wey lose to France for di 2018 World Cup final be like di toughest test so far for five-time champions Brazil.

Penalty Shootout

Croatia 4-2 Brazil

Nikola Vlasic score for Croatia

Rodrygo lose penalty for Brazil

Lovro Majer score for Croatia 

Casemiro score for Brazil

Luka Modric score for Croatia

Pedro score for Brazil

Mislav Orsic score for Croatia

Marquinhos lose for Brazil

Extra Time

FULL TIME: Croatia 1-1 Brazil

120+2mins: Casemiro put im head for di corner but  Dominik Livakovic make a nice save.

120mins: Lovro Majer try im luck wit shot from long distance afta good pass.

Croatia 1-1 Brazil

119mins: Dangerous play by Casemiro. Michael Oliver blows for a foul.

117mins: GOAL! Bruno equalise for Croatia

115mins: Neymar quickly takes the free kick with a short pass.

115mins: Bruno Petkovic make harsh foul becos e wan win di  o ball from im opponent. whistle. Brazil get a free kick.

114mins: SUBSTITUTION. Mislav Orsic enta for Marcelo.

112mins: Pedro make ggressive challenge and Michael Oliver blow for foul.

110mins: SUBSTITUTION. Ante Budimir enta for Borna Sosa.

109mins: Luka Modric break free but an opposing player clear di ball comot.

107mins: Ivan Perisic send cross, but e no locate any teammate inside di box. Poor delivery.

106mins: SUBSTITUTION. Alex Sandro enta for Eder Militao. Fred enta for Lucas Paqueta

106mins: SUBSTITUTION. Lovro Majer enta for Mateo Kovacic.

Croatia 0-1 Brazil

ET Secon Half

105+4: End of first half of extra time.

105+1mins: GOAL! Neymar score for Brazil

105mins: Rodrygo lay di ball to Danilo (Brazil), wey boot am go up.

103mins: Bruno Petkovic find Marcelo Brozovic unmarked on di edge of di box, but e shoot di ball go over di bar.

102mins: Mateo Kovacic produce poor pass.

101mins: Dominik Livakovic block Pedro effort from di edge of di box.

99mins: Rodrygo pass neat ball into  di box in di direction of Lucas Paqueta, di ball too fast.

97mins: Lucas Paqueta and Neymar try to force di Croatian defence open.

95mins: Danilo tip cross into di box, but nobody dey dia to use di pass.

94mins: Borna Sosa make rough challenge and Michael Oliver blow for a foul.

91mins: Long cross from di side to well-positioned Antony but di defender clear am.

Croatia 0-0 Brazil

90mins: First of Exra time don start

Second Half

Croatia 0-0 Brazil

90+5'mins: Referee blow whistle to signal di end of di second half.

90+2mins: Rodrygo take di corner but only send am into di middle of Croatian defenders.

90+1mins: 4mins of added time

90mins: Neymar chip pass over di line of defenders but dem clear am.

89mins: Brazil defender clear Borna Sosa cross.

86mins: Eder Militao react well to get to di rebound and take a shot from di edge of di box.

84mins: SUBSTITUTION. Pedro enta for Richarlison

82mins: Antony try to find Lucas Paqueta, but e put too much power on di through ball.

80mins: Lucas Paqueta receive good pass and shoot from mid-range. Goalkeeper Dominik Livakovic make brilliant save.

78mins: Richarlison commit foul and Michael Oliver immediately signal free kick.

77mins: YELLOW CARD. MARQUINHOS chop card

76mins: Neymar control a reverse pass deep inside di box and amd knack di ball low but Dominik Livakovic push am go corner.

75mins: Ivan Perisic commit foul. Ref Oliver don warn di two teams to dey careful fit dia tackles.

72mins: SUBSITUTION. Bruno Petkovic enta for Andrej Kramaric. Mario Pasalic enta for Nikola Vlasic.

70mins: Ref blow foul against Antony.

68mins: YELLOW CARD. Casemiro chop card for bad tackle

66mins: Dominik Livakovic make brilliant save afta Lucas Paqueta attempt inside di box

65mins: Marcelo Brozovic hold down im opponent to stop im movement. Ref blow for foul.

64mins: SUBSTITUTION. Second change for Brazil. Rodrygo enta for Vinicius Junior.

61mins: Brazil defender clear di ball afta Luka Modric attempt to dribble past opposing player.

58mins: Andrej Kramaric and Marcelo Brozovic attempt to exchange short two-yard passes, but di opposition defence stop di flow.

56mins: SUBSTITUTION. Manchester United forward Antony enta for Raphinha.

53mins: Mario Pasalic try im best to cross into di box, but e no dey enof

51mins: OFFSIDE. Ref catch Andrej Kramaric offside

50mins: Josip Juranovic attempt to find im teammate wit a pass from outside di box, but di Brazilian defence quick stop am.

49mins: VAR dey check for potential offside. Ref say NO PENALTY.

48mins: OFFSIDE. Linesman raise im flag against. Vinicius Junior

46mins: Good save by Croatia goalkeeper, Livakovic

45mins: Croatia 0-0 Brazil

First Half

Half Time: Croatia 0-0 Brazil

45+2': Ref end First Half

45mins: OFFSIDE. Andrej Kramaric time im run too early and di linesman raise im flag

42mins: Neymar fire shot from di free kick straight to di middle of di net, di goalkeeper catch am.

41mins: Michael Oliver blow afta Marcelo Brozovic kick Vini leg instead of di ball.

36mins: Richarlison go on solo run, but e fails to create chance

34mins: Croatia dey lead on possession at di moment.

31mins: YELLOW CARD! Marcelo Brozovic receive caution from di referee.

30mins: Ivan Perisic lack options so e play di shot by im sef from di edge of di box.

29mins: Neymar take free kick wey no dey accurate.

28mins: Josko Gvardiol make bad challenge and leave Michael Oliver wit no oda option dan to blow for a foul. Brazil get free kick.

25mins: YELLOW CARD! Danilo chop card afta e commit foul.

23mins: Casemiro play first-time effort from long range, but defender block am again. Corner kick for Brazil.

20mins: Vinicius Junior in di middle of di box, e look up and shoot but Croatia defender block am.

19mins: Andrej Kramaric shoot from outside di box, but dem block im effort

16mins: Casemiro attempts to slip di ball through di defence, but e no fit locate im teammates.

14mins: Ivan Perisic produce lovely ball into di penalty area but di defender manage to block am go corner.

11mins: OFFSIDE! Flag up against Richarlison

10mins: Good defending. Vinicius Junior try to find Raphinha inside di box, but di pass cut out.

8mins: Mateo Kovacic makes strong challenge and ref Michael Oliver blow for foul.

7mins: Josip Juranovic attempt to find di head of one of im teammates wit better cross into di box, but Brazil defender jump pass am

5mins: Vinicius Junior try im luck wit shot from outside but di keeper catch am wit ease

3mins: Casemiro manage to dispossess im opponent of di ball, but e commit foul in di process

Croatia 0-0 Brazil

1mins: KICK OFF

Croatia vs Brazil Line ups

Croatia: Livakovic, Juranovic, Lovren, Gvardiol, Sosa, Modric, Brozovic, Kovacic, Pasalic, Kramaric, Perisic.

Brazil: Alisson, Militão, Marquinhos, Thiago Silva, Danilo, Lucas Paquetá, Casemiro, Raphinha, Neymar, Vinícius Júnior, Richarlison.

Brazil neva lose in four of dia previous meeting wit Croatia in all competitions.

Croatia don lose four of dia five World Cup games against South American sides, wit a 3-0 win ova Argentina for 2018 as di only exception.

Two of doz four defeats na against Brazil – 1-0 for 2006 and 3-1 for 2014 (both group stages).

Since beating Germany 2-0 for dia final for 2002, Brazil don lose each of dia last five World Cup knockout stage games against European nations.

Brazil dey look to reach di World Cup semi-final for di ninth time, wit only Germany.

Na Real Madrid midfielder Luka Modric dey lead di progress of Croatia.

Though na 37-years-old, Modric don already show why dem bin nominate am as one of di best players for di world.

Dis Qatar World Cup fit be im last major tournament.

Croatia players, Borna Sosa and Josip Stanisic bin missdi win ova Japan becos one sick and di oda get muscle injury.

Brazil go dey without Gabriel Jesus and Alex Telles wey no go involve for di World Cup again sake of knee injury.

Alex Sandro no go also play becos e still dey recover from a hip problem. Danilo dey set to kontinu for left-back.

Previous Post Next Post